Make you turn Your Skills into ALPH: This one na Alphland Bounties Guide

Una Welcome to Alphland platform and Bounties guide!
Dis guide go help you understand everything wey you need to put for head so you fit browse, follow other members join bodi, and earn better rewards from bounties for Alephium ecosystem.
Wetin Be Bounties Sef?
Bounties na tasks wey dey pay moni; wey ecosystem projects post for Alphland. Dem cover different matter from content creation to design and development. As person wey wan run the bounty, as you complete bounties, you go earn rewards or moni if you wan call am so for $ALPH (Alephium native coin). As person dey do this one, you go dey help the ecosystem grow while you dey collect better moni for your work.
Carry for mind say even though all bounties dey paid in ALPH, some listings fit show USD value. For this type, the company people go still pay moni for ALPH based on the current exchange rate after person wey work don complete the bounty.
How e dey work (for 3 steps):
Waka Join bounties from ecosystem projects
Work well well so you fit Deliver high-quality work
Earn ALPH and from there unlock new opportunities wey fit benefit you.
Step 1: Browse Available Bounties
Waka go alph.land/bounty make you see all the opportunities wey full for ground.
For this page, you go see:
• Search bar: Type keywords wey concern you make you quickly find bounties wey match your skills.
• Status filters: Waka Filter bounties by status: All, Open, Closed, or Completed for there.
• Category filters: Try narrow results as you type: All, Content, Design, Development, or other.
• Stats overview: Waka See total value wey people wey don work don earn across the platform, number of open opportunities, and number of completed bounties.
• Bounty cards: Each card wey dey for there go show project logo, bounty title, sponsor name, difficulty level (for example Intermediate), status badge (example Open), category tag, and reward amount.
If you look well for the right sidebar, you go also see Recent Earners (community members wey don recently complete bounties collect moni).
Step 2: Open a Bounty and Review the Details
For there, click any bounty card wey sweet you to open the detail page:
For top, you go see:
• Bounty title and the sponsor (the project wey post am).
• Tags: type (Bounty), status (Open), scope (Global), and difficulty (Intermediate).
• Number of participants wey dey already work on am (For example 2 participants).
• Bookmark icon wey person fit use save the bounty for later. Prizes Tab dey show:
• Total Prizes: For here na total reward pool (example 500 ALPH or 100 USD) person go see.
• Prize distribution: This one na visual breakdown wey go show how rewards go dey shared across positions (1st, 2nd, 3rd, etc.).
• Reward Breakdown table: This table dey show which exact amount for each position. People wey qualify for the price.
• Payment Terms: For here you go see how and which currency dem go take pay you. But carry for mind say normally, rewards dey dey paid in ALPH. For left side you go also see:
• Submissions: How many people don already submit the work wey dey for ground.
• Remaining: Time wey remain before deadline go reach.
• "Submit Now" button: This one na to submit your work once e don ready.
Details section carry:
• Description: Full explanation of wetin the bounty go require.
• Requirements: Better conditions wey person must meet (for example minimum follower count for some social media platforms, content length, tags to use etc).
• Deliverables: Checklist of wetin your submission must include.
You go also see comment section for down if you look wella. Na discussion area wey you fit ask any questions wey enter your mind or follow the sponsor and other participants wey dey for ground talk.
Step 3: Complete the Work and Submit am
When you work finish make you shine your eyes, before you submit, make you make sure say you don log in. If not, click the orange button wey dey for top right of the page and then make you follow the steps complete your profile.
Once your work don ready and you don log in, click the "Submit Now" button for the bounty detail page. Then submission form go commot sharparly.
Sofri Sofri fill these fields:
Submission Title (required): Give your submission better name wey dey clear.
Description (optional): Describe the work wey you do and explain how e meet the bounty requirements.
Submission URL (required): For here, you go provide link to your work we you do (for example GitHub repo, live demo, published post, or documentation).
Additional Notes (optional): Any extra information wey you want share with the sponsor, na here you go write am
Once everything don dey correct, click "Submit Work" to send your entry.
Step 4: Wait for Review and Earn Rewards
After you don submit, the bounty sponsor go use him hand review all entries.
Na wetin go happen next:
The sponsor go use him hand check all submissions based on the requirements and deliverables.
Dem go rank winners (1st place, 2nd place, etc.) according to quality.
Rewards go distribute to top submissions based on the prize breakdown wey we look for up.
Tips for Success
We want make you win. Na how you fit improve your chances we dey talk:
Read the requirements well: Make sure say you meet every condition wey them write before you start.
Check the deadline: Make you make sure say you note the remaining time and from there plan yourself wella.
Look existing submissions: Submission count wey other people don do fit give you idea of competition level.
Use the Comments section: If anything no clear for your eyes, ask the sponsor gon gor.
Quality pass speed: Sponsors dey rank submissions by quality, so make you take your time deliver your best work.
Bookmark bounties: You fit use the bookmark icon save interesting bounties wey you like so that make you fit come back later.
FAQ: Bounties
Question: I need account before I fit participate?
Answer: Yes, you need create account and then log in for Alphland before you fit submit your work. You fit log in with your Gmail account or another email address wey sweet you log in.
Question: How dem dey pay rewards?
Answer: Rewards dey usually dey paid for ALPH (Alephium native coin). Then for bounties wey dem list for USD, dem go convert the amount to ALPH based on the current exchange rate wey ALPH dey when them wan pay you.
Question: I fit submit for multiple bounties at the same time?
Answer: Yes o! You fit work on and submit as many open bounties wey you fit do. For future, Alephium oga them fit consider limiting monthly bounty submissions wey participants fit submit to help them maintain high-quality standards.
Question: Wetin happen if bounty close?
Answer: Closed bounties no dey accept submissions again. So you fit filter by "Open" status to see only active opportunities.
Happy hunting! 🚀 Start to explore bounties today for alph.land/bounty
Disclaimer
This is a community-run blog for third-party contributors. The views expressed here are those of the authors and do not reflect the official Alephium project. This content is for informational purposes only and does not constitute financial, legal or investment advice. Cryptocurrency carries risk and is highly volatile. Information may be incomplete or outdated. Always conduct your own research. We disclaim liability for any loss or damage resulting from reliance on this article.





