Proof of Conviction: Marketing for Time of Mirage

Op-ed by Ratko, Marketing Lead, Alephium.
Hello my better people, una welcome!
This na di first column wey Ratko, our Marketing Lead, write. Plenty people we dey for Alephium community sabi am well well as Quartermaster of the Alephium Guard (our ambassador program wey we dey do). Today, e dey talk about some kain truths wey dey inside crypto industry, so make we shine our eyes well well to see wetin him dey talk.
Note: The views and opinion wey dey here na di writer own, e no necessarily be Alephium official stand.
My papa na revolutionary, and me sef being wan be one before.
If we waka back look 2014, crypto no be like industry atall. E be like movement wey people just dey hear. E be like one kind promise say code fit fix wetin politics no fit fix. So as opportunity show wey person fit use talk, I jump inside am and begin preach about Bitcoin, blockchain, and wetin this new financial system fit mean for ordinary people. I like am. I been like the people, the ideas, and e sweet me well well say I dey part of something wey wan make world be a better place.
But then, after a few years do pass, everything come change. Speed, gains, features, everything wey dey new and shiny. We come lost as we dey waka for road, we too waka fast to the point wey we come forget why we start at the waka in the first place.
When Progress Waka Commot for Road
Wetin I dey try talk be say, e easy to forget when future be like say e dey shine bright. Every revolutionary for this matter come turn potential millionaire for our front. And e get anything wey sweet pass to make money wey at the same time the person dey change the world? E come be like say person be Jesus but him dey live like Bezos.
We build DeFi machines wey dey powered by staking, then we come stake the staking, then borrow against am. Rinse am and repeat plenty times, until e go take you six months to understand wetin the entire web of yields dey talk. Entire ecosystems wey dem build stand ontop promise, dem been raise moni wey reach billions but them pump the money enter something wey no commot any thing except cotton clouds.
The complete Crypto come turn hall of mirror: yield dey pursue yield, liquidity dey pursue liquidity. Everything come be look like millions bucks, literally.
Plenty Plenty Projects come commot full everywhere the entire space come turn to noise. Plenty founders come enter the space dey believe and dream say dem go be the next Trump, McAfee, or Andrew Tate; come become big man wey dey control crowd. Satoshi sef, that poor person don become history, everybody forget am even though say him dey somewhere wey person no know. As the industry be, If him show him face today, dem for don finish am sharp-sharp, him go suffer of Caesar.
But, make we waka go the bright side. For that early time, People come dey respect marketing people turn like say them be native doctors. Everybody carry a “marketing first” approach for mind Developers wey no dey gree answer people before, now come dey listen.
People wey come be marketer turn best job for world.
The Marketing Illusion
E get on time sha. Because of the bull market, marketing come look easy. Every post wey people write dey trend. Every chart dey shoot up. Every partnership, wey people secure no matter how small wey e be, people dey sell am as momentum.
You fit launch meme coin, call am movement, and people go believe kpatakpata. Money dey grow on top tree, everybody wan collect as much as them fit collet sharp sharp.
Crypto marketing come turn fight for attention—KOLs, influencers, celebrities, even ashawo dem come dey sell hype instead of sense. The matter come shift from to build trust to who fit come buy am. Na who come get money pass come dey win. Na pure theater.
But, when market turn turn, the illusions go scatter. Celsius, Terra. FTX. Each crash wey happen for this industry dey remind us say the foundation don spoil kpatakpata tay tay before roof fall.
The theater come stop to dey work. The Community wey carry for mind say the market chart go improve come dey hold bodi until the next bull run.
“Why we never list there?”
“Why we no get big banners or celebrity endorsement?”
“Why person no fit sponsor the next big hackathon?”
“Wen Binance Alpha go drop?”
“Kaito AI!”
Inside all this wahala, while people dey try sell wetin dem no go fit sell, your eyes go open. Real marketing no be noise, na about alignment between wetin you talk and wetin you build. If message waka fast pass product, the image go collapse ontop him own bodi.
Na wetin happen, too much of Web3. Too much smoke and mirrors, with too little substance.
Return of the Lost Children
In these cycles of life, we see what’s up.
After every bull run don happen, the silence dey waka come back. Inside that silence, na him real builders dey show face. People wey remember why dem start. People wey no forget say crypto space suppose be more than speculation.
Them born Alephium from that kind of conviction. One kind Belief say progress no dey come from to carry old principles throwaway; but to improve am.
For technology, we improve PoW well well, make am scalable and efficient.
For economics, we dey build system wey dey reward contributions, instead of speculation. To create new value, make all network participants dey aligned.
For marketing, we dey carry our mind put for credibility over noise. We dey tell stori wey dey match reality.
Sometimes, when noise full everywhere, wetin we go offer no go dey shine shine for eyes. But na confirm. And na wetin dey confirm dey last well well.
Our story fit no be the one wey dey make too much noise make people hear, but e go be one wey dey endure—because them write am for code, community, and conviction. So make you no worry if you no see thousand headlines about us.
Because you go see us here tomorrow. And next tomorrow. And the one wey follow the last one.
That one no just proof of work. Na proof of conviction.
Original article: https://alephium.org/news/post/proof-of-conviction
Disclaimer
This is a community-run blog for third-party contributors. The views expressed here are those of the authors and do not reflect the official Alephium project. This content is for informational purposes only and does not constitute financial, legal or investment advice. Cryptocurrency carries risk and is highly volatile. Information may be incomplete or outdated. Always conduct your own research. We disclaim liability for any loss or damage resulting from reliance on this article.






