Skip to main content

Command Palette

Search for a command to run...

After the Boom: Why 2025’s Prediction Market Surge Need Make E Decentralized [Part 1]

Updated
6 min read
After the Boom: Why 2025’s Prediction Market Surge Need Make E Decentralized [Part 1]

Na Hayden write dis article and na him be the founder of Aura Markets. Aura Markets na one upcoming decentralized prediction market platform wey dem one join bodi for Alephium gon gor.

Note: Abeg the thing wey I talk for the article no mean say na Alephium dey officially talk am.


Dis past year been sweet well- well gidibga for prediction markets.

Platforms wey dey for ground tanga like Kalshi and Polymarket don break plenty records, with the kind trading volume wey dem dey do wey reach almost $60 Billion for 2025 alone. Kalshi dey do almost $1 Billion trades per week now (the trade reach over $50 Billion if you check am annually), Kalashi waka go up reach 1000% pass wetin e dey do last year.

Dem valuation sef follow enter matter wey people dey talk. Kalshi valuation don waka reach $11 Billion by end of 2025 (e bin dey $5 Billion before after dem raise $300 Million earlier for di year). Polymarket sef try well-well reach $12–15 Billion valuation based on dis kind momentum wey the market dey maintain.

Mainstream media sef don dey notice wetin dey happen. CNN don partner with Kalshi to put better real-time prediction markets inside their personal news coverage, that one na clear sign say dis kain market don enter public mata.

If we check am well-well, 2025 na di year wey prediction markets enter mainstream gon gor. Di sudden boom wey happen for the market don show say people believe say you fit trade on top wetin go happen for real world, and e fit turn into big industry. But as the founder of Aura wey I be, I dey look am small- small with fear-fear, though morale dey my mind.

If you look am well-well, di better volumes and gbrekete headlines dey show say di idea dey make sense, but e dey also show one kind wahala wey dey for ground: today’s prediction market dey make sense mostly for centralized market, na there e dey happen, for corporate platforms. But the matter dey make person laugh because dis kain market suppose dey boom from Web3 decentralization spirit.

Di success wey we dey celebrate now fit dey waka ontop weak foundation wey no strong atall, foundation wey dey contradict di main principles of open, trustless finance.

Validation at a Cost: Di Centralization Wahala

Dis kain boom wey we dey experience now na double edge sword. For one hand, e dey show say prediction markets fit scale well. Decentralized projects wey first commot like Augur and Omen don already show say di idea get potential, now Kalshi and Polymarket don show say e fit reach plenti tens of billions in volume, and dem fit turn the sector into multi-billion dollar business.

For di other hand, di growth don come waka enter Web-2 style model. Dis one get walled gardens, company control, and di same old wahala wey dey centralized systems if you look am well-well. Na Pyrrhic victory dis one be for we wey believe for original Web3 vision.

Di interest wey dey enter market dey sweet die, but e no suppose cost too much. E for better make we ask say: “Wetin we dey pay for this centralized success, and e get beta way wey we fit take do am?”

I don see some big kasla wey dey centralized prediction platforms wey fit spoil di long-term better of dis industry.

Single Point of Failure

Corporate prediction markets dey usually dey controlled by one company and na the company dey control di platform. Dem dey decide wetin fit dey trade, how markets go settle am, and whether dem fit shut down markets or di whole service anytime dem want.

Dis kine “Aso Rock” dey get plenty failure points, from censorship, wuru wuru outcome manipulation, to technical wahala wey fit freeze trading. Users dey for the hand of one platform uptime and integrity and them no get mouth to talk. If corner-corner market topic vex di company or regulators, dem fit block am sharp-sharp. If dem no settle market better, traders no go get mouth to talk.

In short, you suppose carry mind put for di middleman, but Web3 suppose dey trustless.

Regulatory Fragility

Since dem dey run di platform as business gon gor, dem dey exposed to all kain local regulations and political pressure. One court order or law fit shut down di whole market before you know wetin dey happen.

We don see this kain thing before, for example, when Polymarket gatz block US users for 2022 and then come ask dem say make dem pay fine afta regulators show body. Kalshi sef fight CFTC for many years just to dey list election markets.

If you carry mind put for one centralized exchange, one country policy fit cut access for people. Dis kain shaky shaky dey choke di hand of prediction markets. Di promise na global insight, but centralized platform fit off light anytime for that collective intelligence with just one pen stroke.

Users Dey Rent, No Be Owners

Di most serious wahala be say economics dey collect from users hand. For tanga platforms, na users dey create value. Dem dey trade, dey provide better talk, dey give liquidity, but all di profit wey dey commot and power dey enter di platform owners and investors hand.

Exchanges dey hold informe, dey collect fees, dey increase valuation (like Kalshi $11 Billion jump), while users no see anything cha cha. Users dey rent di platform. Dem dey pay fees (wey fit high well-well), but dem no get ownership atall or voice for governance for the platform.

Person activity dey make the platform make sense well-well but di value dey go only corporate stakeholders hand. E no just make sense, and e bad for long term matter because users no get talk for di game outside their own bets.

Web3 Dey Undermined

All these mistake dey fall Web3 hand well-well and open finance. Prediction markets matter suppose dey free people, dey turn infome to asset wey person fit use trade without gatekeepers. Instead, we dey redo di same centralized silo wey few hand dey control and profit.

E no suppose dey like this.

Di next era of prediction markets fit and suppose follow another lane jeje, one wey dey decentralized, trustless, and na community properti. For Aura, dis gidigba matter na our North Star.

Wetin Next?

For Part 2, Aura founder, Hayden, go show solution wey go solve centralized wahala kpata kpata, with open, community-governed prediction market protocol wey go bring back Web3 roots to users hand, still fit scale like corporate platforms. Dis solution, wey dem dey build on Alephium, go focus on trustless, community-led resolution (where $AURA stakers dey govern outcomes), community ownership via $AURA (where fees dey recycle to reward all contributors), and markets wey users use their hand make (wey allow original, bottom-up content), all this time dey smooth like Web2 experience with stablecoins and gas abstraction dey make decentralization easy to use.


Disclaimer

This is a community-run blog for third-party contributors. The views expressed here are those of the authors and do not reflect the official Alephium project. This content is for informational purposes only and does not constitute financial, legal or investment advice. Cryptocurrency carries risk and is highly volatile. Information may be incomplete or outdated. Always conduct your own research. We disclaim liability for any loss or damage resulting from reliance on this article.

More from this blog

A

Alephium Gazette

133 posts

Join us on this exciting journey as we explore the limitless possibilities of the Alephium blockchain and empower individuals and organizations to thrive in the decentralized future.